When YAHOO - YAHOO Dream Turn To Village Wahala

 One young guy sell him only land wey him papa leave for am — na the only inheritance wey suppose be him family house. E sell am for the normal market price.

After the sale, the guy use the money buy iPhone. He talk say na the phone him go use start Yahoo business 🤣🤣. E even carry him babe come dey live with am.

Years pass, the Yahoo no pay, him no blow. The money finish las las. But as dem dey struggle, the girl born fine baby boy 🤣🤣.

Now, the person wey buy the land don show face to develop am, but the guy don dey para.

He talk say he no sell the land with clear eye 🤣, say make the buyer no enter the land.

Now he dey beg for time to return the money or he dey threaten say person go collect 🤦🏽‍♂️.

W


etin be this kind wahala like this? 😩


Comments

Popular posts from this blog

Bolt's 45% Commission Outrageous :A Driver's Experience That Raises Serious Concerns

Registered Toyota Corolla 2005/2006 Sport For Sale

Uber Driver Caught Another Man Sleeping With His Wife On Their Matrimonial Bed